- Olaronke Alo
- Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos
Ghana elections 2020 campaigns don end, 7 December polls now de election proper be upon us.
So for help Ghanaians get better understanding of de issues affecting Monday voting, BBC Pidgin torchlight de west African country economy and corruption scorecard since 2012.
Ghana election 2020 na majorly between two candidates wey don once serve as President for Ghana within di last eight years.
Former president John Dramani Mahama of de National Democratic Congress and di incumbent president, Nana Akufo-Addo of de New Patriotic Party be de main contestants for Ghana 2020 presidential race.
Dis time de tweo candidates dey ask for four more years to make Ghana great again.
Make we take a look at some key sectors, wetin dema promise versus wetin dem achieve for dia first term for office.
Economy
NDC Manifesto promise for 2012
To focus im economic development priorities to better di lives of Ghanaians through investment
• Maintain single digit rate of inflation;
• Ensure exchange rate stability
• Reduce gbese significantly
• Maintain average annual growth rate of at least 8%
NPP Manifesto promise for 2016
To build di most business-friendly and pipo friendly economy for Africa, wey go create jobs and prosperity for all Ghanaians.
Achieve double digit GDP growth annually for four years
Reduce di cost of doing business, maintain financial discipline, reduce government borrowing
and reduce interest rates to encourage private businesses.
How tins be?
Tori pipo for Fact check Ghana bin do research and dis na wetin dem find out as dem quote World Bank data to compare di monetray value and di GDP under di tenure of di Mahama-led NDC government and di incumbent Akufo-led NPP.
From dis table, e show say under di Mahama-led NDC government, Ghana record GDP growth of 15.836 wey be average of 3.959% growth every year.
Akufo-led government don record an accumulated growth of 21.784% wey translates to an average of 5.446%.
Dis one mean say di GDP of Ghana don grow higher under di NPP goment than di NDC.
Corruption
NPP manifesto for 2016 promise;
To commit to establish solid, efficient machinery for good governance, wey go make up of accountable goment and respect for di rule of law and human rights.
One of di things wey dem promise to do na to establish, by Act of Parliament, di Office of di Special Prosecutor, wey go dey independent of di Executive,
Di special prosecutor go investigate and prosecute certain categories…
Read More: John Mahama vs Nana Akufo-Addo: Ghana elections 2020 economy and corruption